Postby Speakr4thedead » Mon Nov 26, 2007 3:56 pm
Through the Fire and Flames - Dragon Force
The Lord na my shephard, I dey kampe.
E make me sidan for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermacool.
E panel beat mai soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness sake of His name.
Walahi!, if I come pass dey where arm robber, 419 and juju people boku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth.
Your rod and staff nko ?
Na so dem dey like back bone dey comfort me.
You don prepare Egusi and Pounded Yam make I chop.
All mai enemies dey look waa waa.
You rub me for head wit vaseline intensive lotion.
Mai cup na River Niger wey overflow hin bank.
True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench.
And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai.